Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 10:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Bikos nor bi who praiz ensef dey rite, but na di pesin wey God like to praiz.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 10:18
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey praiz pesin wey get sense, but nobody dey respet wiked pesin.


Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.


So make yu let odas praiz yu, instead of yu to dey praiz yorsef.


But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.


“Israel pipol, make una hear wetin I dey tok, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di man wey God choose and wey e send to una, wey God use do many mirakles and oda wonderful signs for una front, as all of una know,


If yu serve Christ like dis, God go dey happy with yu and pipol go respet yu.


Make una greet Apelles for mi, bikos Jesus Christ don choose am. Den make una still greet Aristobulus family for mi.


but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.


Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Wi nor go kompare awasef with doz wey sey dem good well-well or kon put awasef for di same group. But wen dem dey measure and kompare demsef with demsef, e dey show sey dem nor get sense.


Wi dey pray to God make una nor do anytin bad; wi nor dey do am to show sey wi pass di test, but make una for do wetin good, even if e bi like sey wi fail di test.


Wi don dey boast about awasef again? Wi nor nid una to rite sey, wi dey good, even doh odas dey wont am like dat!


Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind.


But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times;


Make yu do evritin wey yu fit do, so dat God go si yu as betta pesin. Dey do yor work well as pesin wey nor dey shame, but dey ready to esplain God word wey bi trut.


Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ