Anybody for di land wey ask for blessing, God wey dey faithful go bless am. Anybody wey won swear, go use God name wey bi trut take swear and dis na bikos di trobol wey dey before, don pass and I go forget dem forever.”
den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.