Wi nor go kompare awasef with doz wey sey dem good well-well or kon put awasef for di same group. But wen dem dey measure and kompare demsef with demsef, e dey show sey dem nor get sense.
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.