My brodas and sistas, I wont make una know sey I don plan to kom visit una many times, but God nor let mi kom until naw. Bikos I won gain from una faith as I don do with Gentile pipol.
If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.
Una don really get evritin wey una nid! Una don get plenty money! Una don turn king with us! How I wish sey una really bi king, so dat wi go dey rule with una.
Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us;
But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”
David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”