E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Naw I dey happy, nor bi bikos una dey vex, but bikos una vexnashon make una turn from sin kom meet God. Na so God plan una vexnashon, so dat bad tins nor go happen to una bikos of dis vexnashon wey wi kause for una.
Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
Mi John, I bi una broda and I dey follow una share from di trobol bikos of di kingdom and dey bear di sofa wey dey inside Jesus. Dem porshu mi go Patmos Island, bikos I dey prish God word and tok about Jesus Christ.