Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 1:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 1:23
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta dis tins, Paul komot from Atens go Korint.


Krispus, di oga for di sinagog and en family, plus many Korint pipol wey hear about Jesus Christ, bilive and dem kon baptize dem.


God wey I dey serve and prish en pikin gospel, na-im fit bear mi witness sey I always dey remember una


Na di trut I dey tok, na Jesus get mi and di Holy Spirit dey bear witness for my mind sey, I nor dey lie wen I sey,


Wish one una wont? Make I karry kane kom meet una, or make I kon show una di love wey di Spirit dey give pesin?


So make una give dat pesin to Satan make e ponish am, so dat en sin go komot for en body and Christ go save am for di last day.


Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am, naim and Timoti awa broda, rite dis leta go give God pipol for di church wey dey Korint and to all di good brodas for Akaia.


But as God dey faithful, wetin wi dey prish give una nor bi make e for bi just “Yes” or “No.”


I take am beg una, so dat wen I kom, I nor go nid to tok with vexnashon about pipol wey si us like yeye pipol (bikos I dey fear sey na so e go bi).


True-true, as Christ trut dey inside mi, nobody go fit stop mi for di way I dey boast for Akaia.


Why? Na bikos I nor love una? No! God know sey I love una!


God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok.


Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.


Na dis make mi dey rite all dis tins since I nor dey with una, so dat wen I kom, I nor go vex for una bikos of di authority wey I get and God give mi dis authority to build; nor bi to distroy.


Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,


Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol;


God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true!


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


As una know, wi nor ever try to win una with sweet words. And God na awa witness sey wi nor dey pritend to bi una friends bikos of una money.


Hymenaeus and Alexanda na ezample of doz kind pipol. I don give dem to Satan, so dat dem go stop to dey tok anyhow about God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ