Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Korintians 1:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Korintians 1:17
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”


En profets sturbon and dem dey lie; dey tok only wetin go give dem money. En priests nor gri obey God kommand, so dem don spoil and make di temple dirty with di bad tins wey dem dey do.


Josef wey won marry am, na pesin wey dey fear God well-well and bikos e nor won disgrace am, e kon tink for en mind sey e nor go marry Mary again.


Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”


Una dey judge pesin with wetin una si with una eye, but I nor dey judge pipol like dat.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


Since some pipol dey boast like dis world pipol, make mi mysef still boast.


E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi


I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.


Wi bin won kom si una (mi wey bi Paul don try to kom many times), but Satan spoil awa plan.


My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.


Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ