But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.