9 As I do Jeroboam, Nebat pikin and Baasha, Ahijah pikin with dia shidren-shidren, na so too I go distroy Ahab shidren-shidren.
At wons, e bigin kill all Jeroboam family. So dat wetin God tok thru Profet Ahijah from Shiloh, go happen. Dem kill evribody for Jeroboam family and no one remain.
Yor family go bi like King Jeroboam wey Nebat born and like Baasha wey bi Ahijah pikin. Bikos yu don make mi vex, as yu make Israel pipol dey sin.’
Den Jehu kill di odas for Ahab family wey dey Jezrel, plus all en ofisas, klose friends and priests. E nor leave any one.