Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 9:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Jehu look up kon shaut, “Na who dey my side?” Like two or three kourt ofisas look am from di window.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 9:32
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As Jehu enter thru di gate, Jezebel kon sey, “Zimri, yu wey kill yor oga! Hope evritin dey okay? Wetin yu dey do for here?”


So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.


Yu go distroy yor oga, Ahab family. I go revensh Jezebel bikos of my savants, di profets wey e kill.


Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.


Shield and spear dey for evry town. E make dis town strong well-well. Na-im get Judah and Benjamin.


For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,


Time kon rish for Estha to go meet di king. Estha na Abihail pikin and Mordekai kousin and anybody wey si am, dey like am. Wen e turn rish, e wear wetin Hegai wey dey kare for dem sey make e wear.


One day wen Mordekai dey work for di palis gate, Bigtan and Teres wey bi ofisas wey dey guide di king door-mot kon dey vex and plan to kill King Zazes.


God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?


Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?


So Moses stand for di kamp gate kon shaut sey, “If yu dey God side, make yu kom meet mi.” Den Levi tribe gada go meet am.


Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ