Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
King Josaya savant karry en oga dead body from Megiddo on-top horse go back to Jerusalem for where dem for beri am for en grave. Di pipol for di land take Josaya pikin, Jehoahaz, pour olive oil for en head kon make am king for Judah.
Dem find Ahazaya until dem si am for where e hide for Samaria. Dem bring am kon give Jehu and e kill-am. Dem just beri en body, bikos dem dey respet en grand-papa, King Jehoshafat, wey use all en mind take serve God. E nor get anybody for Ahazaya family wey remain to rule as king.
So, en savants karry am for anoda shariot go Jerusalem where e for die. Dem beri am for en grand-grand papa grave and all di pipol for Judah and Jerusalem, kry well-well.