Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 9:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 9:27
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One day, Ahab tell Nabot, “Make yu give mi yor vineyard wey dey near my palis, bikos I won use di land take do vegitabol farm. I go give yu anoda vineyard or pay yu betta prize for dis one.”


Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.


Dem fear well-well kon sey, “Si! If two kings nor fit stop yu! How wi won take stop yu?”


Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family.


For di sevent year wen Jehu dey rule, Jehoash kon bi king; e rule Judah for forty years from Jerusalem. En mama na Zibaya wey kom from Beersheba.


Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.


Dem plan against am for Jerusalem, so e run go Lakish. But dem send some men go find and kill-am for der.


Amon savants kon plan and kill-am for en palis.


King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.”


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.


Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der.


Kanaan kings kom fight for Taanak near Megiddo wota, but dem nor take any silva komot der.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ