22 Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?” Jehu ansa, “How evritin won take dey okay wen yor mama still dey make pipol serve juju and do oda bad tins.”
So dem send one man go meet Jehu kon ask, “Di king dey ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ” Jehu ansa, “E nor koncern yu, just follow mi.” Di gateman kon go tell di king, “I send pesin go, but e neva kom back.”
instead, yu dey sin like Israel kings. Yu make Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem turn from God, just as Ahab family do for Israel. Yu still kill yor brodas and yor papa family wey betta pass yu.
Even lantan lite nor go ever shine inside yu again! Dem nor go ever hear sey man and woman dey marry inside yu again. Na yor tradas get pawa pass for dis world, bikos yu take yor majik deceive all di oda kountries!
Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”