20 Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”
Di guide kon sey, “Di first man wey I dey si so, dey run like Ahimaaz.” Di king ansa, “E bi good man and e dey bring good news kom.”
Anybody wey eskape and Hazael nor fit kill-am, Jehu go kill-am and anybody wey eskape from Jehu, Elisha go kill-am.
Jehu kon tell am, “Follow mi, so dat yu go si how I dey sirious about God work.” So Jehu karry Jehonadab follow body.
So e send anoda pesin go ask, “Dis na wetin di king ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ” Jehu ansa dis one too sey, “E nor koncern yu, just follow mi.”
Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
Na mi kreate di man wey dey melt gold, make fire and form weapon and na mi still kreate di soja wey dey use di weapon kill pipol.
Den, dem go gi-am trobol from nort and east and e go-go fight with all en pawa kon distroy and kill many pipol.
I won give Babilon pipol pawa; doz wiked pipol wey nor dey sorry for odas. Dem go mash round di world kon seize all di oda nashons.
Yu vex mash pass di eart and as Yu dey vex, Yu kon skata all di nashons.