Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 9:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 9:2
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.


Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”


Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”


Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria.


Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”


Wen e rish der, Jehu wey bi di sojas oga, sidan for der. So e sey, “Offisa, abeg, I get message for yu.” Jehu kon ask, “Na wish one of us yu dey tok to?” E ansa, “Oga, na yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ