King Ahazaya join King Joram for Israel go fight King Hazael for Siria for Ramot for Gilead where Siria pipol for win and wound King Joram for di fight.
King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.
Ahab pikin, King Joram go Jezrel go heal di wound wey e get for Rama wen dem dey fight against King Hazael for Siria and Jehoram pikin, King Ahazaya kon go visit am.