Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu.
Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”
Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.