Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 9:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Wen Jehu go back go meet di oda ofisas, dem kon ask am, “Yu dey okay? Wetin make dis mad man kon visit yu?” Jehu ansa, “E nor dey important! Una know dis pipol with di way dem dey tok.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 9:11
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu run go meet am kon ask am, ‘Evritin dey okay? Yor husband dey okay? Wot about yor pikin, e dey okay?’ ” Wen di savant run go meet and ask am, di woman ansa am, “Evritin dey okay.”


So Gehazi porshu Naaman. Wen Naaman si sey pesin dey run kom meet am, e kom down from en horse kon ask, “Hope evritin dey okay?”


But dem sey, “Yu dey lie! Make yu tell us wetin e tok.” Jehu ansa, “E tell mi sey, God tok sey: ‘I don choose yu to bi king for Israel.’ ”


Naw, di gateman stand for di gate for Jezrel kon si Jehu men dey kom. So e sey, “I si some men dey kom!” King Joram kon orda sey, “Make yu send one pesin go mi dem kon ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ”


So e send anoda pesin go ask, “Dis na wetin di king ask, ‘Hope evritin dey okay?’ ” Jehu ansa dis one too sey, “E nor koncern yu, just follow mi.”


Wen yu rish der, make yu find Jehu, Jehoshafat pikin and na Nimshi bi Jehoshafat papa, den take Jehu go one room.


Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?” Jehu ansa, “How evritin won take dey okay wen yor mama still dey make pipol serve juju and do oda bad tins.”


Trut nor dey awa mout again and di pesin wey nor dey won do evil, dem dey take en tins from am. God dey look and vex, bikos betta judgement nor dey una body.”


‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun.


Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.


Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”


Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”


So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.)


As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!”


Bikos of Christ, pipol dey si us as fools, but God don make us wise. Wi weak and dem hate us, but dem dey respet una wey dey strong.


If wi dey kraze, na bikos of God; but if wi nor dey kraze, na bikos of una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ