Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 8:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 As Gehazi dey tell di king how Elisha take wake pesin wey don die, di woman wey Elisha wake en pikin, waka kom ask di king about en house and lands. So Gehazi sey, “My oga di king, dis na di woman and en son wey Elisha wake from deat!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 8:5
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Ben-Hadad for Siria gada all en sojas, with thirty-two oda kings, with dia horse and shariot, den dem mash go attack Samaria.


E kon tell en savant Gehazi, “Make yu go koll di woman kom.” So di savant do as e tell am and di woman kon follow am kom.


Den Elisha get up kon dey waka up-and-down for di house. E waka go meet di pikin kon sleep on-top am again, den di boy kough seven times kon open en eye.


One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”


As Israel king dey strol pass di town wall, one woman kon shaut, “My king, make yu help us o-o!”


Di king ask di woman weda di story na trut and di woman kon tell am evritin. So di king tell one of en kourt ofisas sey make e kare for di woman, den e orda dem, “Make una give dis woman en house and land back, plus di money for evry fruit wey di land produce from di day wey e komot from dis town kom rish naw.”


So Zeresh en wife and en friends kon sey, “Go make one pole where dem dey hang pesin put and make e high rish seventy-five fit. Tumoro morning, make yu tell di king sey make dem hang Mordekai for der, den belle go sweet yu go di party.” Haman like wetin dem tok, so e kon make di pole.


I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.


Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


So Rut kon go gada rice for di field wey bi Boaz, wey kom from Elimelek family, own.


Wen Saul know sey na David, e kon sey, “David my pikin, na yor vois bi dat?” David ansa, “Yes! My oga di king, na my vois.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ