Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 8:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 King Ahazaya join King Joram for Israel go fight King Hazael for Siria for Ramot for Gilead where Siria pipol for win and wound King Joram for di fight.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 8:28
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Anybody wey eskape and Hazael nor fit kill-am, Jehu go kill-am and anybody wey eskape from Jehu, Elisha go kill-am.


Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead.


Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.


Den e send message go meet King Jehoshafat for Judah sey: “Moab king sey en won fight mi. Yu go follow mi go fight am?” King Jehoshafat ansa, “Okay! I go follow yu, bikos as yu bi, na so I bi too. My pipol na yor pipol and my horse dem na yor own too.”


Di next day Hazael take small klot, put am for wota kon use am dey tosh Ben-Hadad face until e die. Den Hazael kon bi Siria king.


King Joram go back to Jezrel go trit ensef bikos of di wounds wey Siria sojas giv-am, wen e fight King Hazael. So King Ahazaya, Joram pikin kon go visit am.


Naw, Elisha koll one among di profet sons kon sey, “Wear yor klot, den take dis olive oil kontaina go Ramot for Gilead.


Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria.


So Jehu tell di oda ofisas, “If una dey with mi, make una make sure sey nobody komot from Ramot go warn Jezrel pipol.”


Den Jehu enter en horse kon go Jezrel, bikos dem dey trit Joram for der. (For dis time, King Ahazaya for Judah don kom visit Joram.)


So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut and God help am.


Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.


E follow dia advise kon go join Ahab son, King Joram for Israel. Dem go fight against King Hazael for Ramot Gilead wey dey Siria and Siria pipol win King Joram and en men.


Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe.


From Gad tribe, dem give dem: Ramot for Gilead (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Mahanaim,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ