King Jehoram na thirty-two years wen e bi king and e rule for eight years from Jerusalem. En deat nor pain anybody at-all and dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
Pipol wey dey stay Jerusalem kon make Jehoram yongest pikin king, bikos Arab pipol wey skata di town kill all di oda shidren. So Ahazaya wey bi Jeroham pikin kon bi king for Judah.