Di king die just as God tok thru Elijah. For di sekond year wey Jehoshafat pikin, Jehoram bi king for Judah, Ahazaya broda wey bi Jehoram kon bi king for Israel, bikos di former king nor born boy at-all.
So King Joram dota, Jehosheba, wey bi Ahazaya sista, eskape with Ahazaya pikin, so dem nor kill-am with di oda king shidren. Jehosheba keep di boy with en nurse for one room where dem dey keep tins inside di temple, so dat Atalaya nor go fit si and kill-am.
Pipol wey dey stay Jerusalem kon make Jehoram yongest pikin king, bikos Arab pipol wey skata di town kill all di oda shidren. So Ahazaya wey bi Jeroham pikin kon bi king for Judah.