If wi enter di town, hongry go kill us and if wi stay here, hongry go still kill us! So make wi go Siria sojas kamp. Di highest wey dem fit do, na to kill us, but may bi dem go fit still sorry for us.”
bikos God don make Siria sojas hear nois like sey many sojas with dia shariot dey kom fight dem. So Siria sojas tell demsef, “Si, Israel king don go hire Hit and Egypt kings with dia sojas, so dat dem go kom attack us.”
“Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye.