15 As di men dey travel go Jordan aria, na klot and swods wey Siria sojas drop as dem dey run, full di road. So dem go back kon tell di king wetin dem si.
Den Samaria pipol rush enter Siria kamp kon pak evritin wey dey der. And as God tok, three kilogram for di best flower or six kilogram for di best korn, dem kon dey sell am for one silva.
Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?
En whole family go dey popula bikos of am, dat is evribody wey rilate to am, go dey popula. Bikos of am, en family go balance like plate and pot wey dem hang for wall.
Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.