2 Kings 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English12 By dat time, day don dark well-well, but di king tell en ofisas, “I go tell una wetin Siria sojas dey plan! Dem know sey honga one kill us, so dem don leave dia kamp go hide, bikos dem dey hope sey, wi go leave awa town go find food for dia kamp, den dem go katch us alive kon konker dis town.” အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
One of di ofisas ansa, “Di pipol wey dey di town don taya already, bikos dem bi like pipol wey don already die. So make wi send some men with five horse from di ones wey remain for di town. (Even if dem kill dem, na di same tin go still happen to evribody wey dey Israel, bikos all of us go still die!) Make wi send dem go, so dat wi go really know wetin dey happen.”