By dat time, day don dark well-well, but di king tell en ofisas, “I go tell una wetin Siria sojas dey plan! Dem know sey honga one kill us, so dem don leave dia kamp go hide, bikos dem dey hope sey, wi go leave awa town go find food for dia kamp, den dem go katch us alive kon konker dis town.”