27 Di king ansa, “No! If God nor help una, na how I won take help una? I fit give una korn wen korn nor dey? Abi I fit give una wine wey I nor get?”
Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa.
As Israel king dey strol pass di town wall, one woman kon shaut, “My king, make yu help us o-o!”
Den di king ask di woman, “Wetin bi yor problem?” Di woman ansa, “One woman sey, ‘Make yu give mi yor pikin make wi chop today, den wi go chop my own tumoro.’
Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.
Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help dey yuzles.
My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.
Time dey kom wen di mountin where di temple dey, go dey important pass evry oda mountin. Many nashons go-go der
God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.