19 Den Elisha tell dem, “Dis nor bi di rite road or town. Make una follow mi and I go take una go meet di man wey una dey find.” So e karry all of dem go Samaria.
Wen dem don enter Samaria, Elisha kon sey, “My Oga God, make Yu open dia eye, so dat dem go si.” So God open dia eye and dem kon si sey dem dey inside Samaria.