12 One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.
Wen Elisha, God profet hear sey di king tear en klot, e kon send pipol go meet and tell di king, “Wetin make yu tear yor klot? Send am kom meet mi and e go know sey Israel really get betta profet wey God send kom.”
Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota.
Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”