Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 5:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 5:26
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

sey I nor go take anytin wey bi yor own. Nor bi even yor rope or sandal. So dat yu nor go sey, ‘Na mi make Abram get money.’


But Elisha ansa, “God Forbid! As long as di Oga God wey I dey serve dey alive, I nor go take anytin from yu.” Naaman beg am well-well, but e nor gri.


One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”


But di king go happy bikos of God love. Evribody wey trust God go dey boast, bikos pipol wey dey lie, go shut up forever.


Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.


God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.


Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”


“My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”


Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too.


Since una know mi, I nor put eye for anybody gold, silva or koat.


Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”


So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”


I know sey I nor dey der with una naw, but I dey with una for spirit. And I don already judge di pesin, just as I go do if I dey der.


And even if I nor dey der with una, my spirit dey der and I dey happy sey una mind nor dey shange and una faith for Christ, still strong well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ