Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 5:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 But Elisha ansa, “God Forbid! As long as di Oga God wey I dey serve dey alive, I nor go take anytin from yu.” Naaman beg am well-well, but e nor gri.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 5:16
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di profet ansa, “Even if yu give mi half of evritin wey yu get, I nor go chop or drink anytin with yu.


E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”


Elijah kon sey, “As long as God wey get pawa wey I dey serve dey alive, I go let King Ahab si mi today.”


Elisha kon sey, “As long as di God of all gods dey alive and as I stand for en present, if nor bi sey I dey respet King Jehoshafat, I nor for even look yor face.


Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”


Elisha kon tell am, “My spirit dey der with yu wen di man kom down from en horse kon meet yu. Dis nor bi di rite time to kollect money, klot, olive oil, vineyard, animal or savants.


But Daniel ansa, “My king! Make yu keep yor gifts kon honor anoda pesin. But I go read wetin dey di wall kon tell yu wetin e mean.


Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too.


Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.


Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ