But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
Dem kon dey laf am. Jesus drive dem go outside, kon take di pikin papa and mama with di disciples wey follow am go inside di room where di pikin dead body dey.
Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.
But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.