Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 4:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Den Elisha get up kon dey waka up-and-down for di house. E waka go meet di pikin kon sleep on-top am again, den di boy kough seven times kon open en eye.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 4:35
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Elijah liedan on-top di pikin three times dey pray kon sey, “My Oga God, make Yu give dis pikin life again!”


God ansa Elijah prayer, so di pikin kon kough and start to breath again.


Leta e tell en savants, “Make yu go look di side wey di sea dey.” So di savant go look am kon kom back sey, “Nor-tin dey der.” Elijah kon send am go look again for seven times.


One day, some men dey beri pesin wen dem si some pipol dey kom attack dem. So dem kon trow di dead body inside Elisha grave. As di dead body tosh Elisha bone, di man wey don die kon wake-up.


Elisha koll Gehazi kon sey, “Make yu go koll di Shunem woman kom.” So Gehazi go koll di woman. Elisha tell am, “Make yu go karry yor pikin.”


Elisha sey make en savant go tell Naaman, “Make yu go wosh yorsef seven times for Jordan River, den yu go well.”


So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.


So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.”


As Gehazi dey tell di king how Elisha take wake pesin wey don die, di woman wey Elisha wake en pikin, waka kom ask di king about en house and lands. So Gehazi sey, “My oga di king, dis na di woman and en son wey Elisha wake from deat!”


Naim di girl spirit enter di body back and e kon get up at wons. Den Jesus tell dem make dem give di pikin food chop.


But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ