32 Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed.
Afta sometaim, di woman pikin kon bigin sick. Bikos di sickness strong well-well, di pikin kon die.
So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”
So e enter inside di room, klose di door kon pray to God.
Wen Jesus rish Betany, dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus.