Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 4:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Gehazi don dey go for dia front. E put di walkin stik on-top di pikin face, but di boy nor even shake body, so e kon go back go tell Elisha, “Di boy nor wake-up o-o.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 4:31
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dem take one melu as Elijah tok kon kill-am put on-top di firewood wey dem arrange. Dem koll dia juju, Baal name from morning go rish aftanoon kon dey sey, “Baal! Make yu ansa us o-o.” But e nor ansa dem, even as dem dey jump anyhow for di altar wey dem make.


Dem shaut and kry till aftanoon, but dem nor hear any sound, ansa or anytin.


Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed.


Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”


So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.”


na so too pipol wey die nor go kom back again. Dem nor go fit si di sky for day time again, bikos dem don sleep go.


“Man pikin, dis pipol don give dia heart to juju and na di juju dey make dem sin. Dem tink sey I go ansa dem?


Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.


Wen Jesus enter, e tell dem, “Why una dey kry like dis? Di pikin neva die, e just dey sleep.”


Den Jesus tell dem, “Awa friend Lazarus dey sleep, but I won go wake am up.”


Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”


So Saul ask God, “Make wi porshu Filistia pipol? Yu go give dem to us?” But God nor ansa am dat day.


So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ