22 E koll en husband kon sey, “Abeg make yu send one among yor savant and one donkey kom, so dat I go kwik rush go meet di profet kon kom back.”
So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
But di husband ask, “Wetin make yu wont go si am today? Today nor bi new moon or Sabat Day.” But di woman ansa, “Evritin dey okay.”
Den e enter di donkey kon tell en savant, “Make yu drive fast as yu fit drive rish, unless I sey make yu slow.”
Make yu run go meet am kon ask am, ‘Evritin dey okay? Yor husband dey okay? Wot about yor pikin, e dey okay?’ ” Wen di savant run go meet and ask am, di woman ansa am, “Evritin dey okay.”
So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.
Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.”