2 Elisha ask di woman, “Wetin yu wont make I do for yu?” Make yu tell mi, “Wetin yu get for yor house?” Di woman ansa, “Yor savant nor get anytin escept one small oil.”
Di woman ansa, “I promise with God wey dey alive sey, I nor get bread. Di only tin wey I get na small flower for plate and olive oil for cup. I kom gada firewood make I use take make am for mi and my pikin. Na dat one bi di last food wey wi go chop before honga go kill us.”
Afta dem don waka pass, Elijah kon tell Elisha, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu, before God go take mi go heaven.” Elisha ansa, “Abeg! Make yu let mi get doubol of di pawa wey yu get.”
Pita kon tell am, “I nor get silva or gold to give yu: but na wetin I get, I go give yu. With Jesus Christ name wey kom from Nazaret, stand up make yu bigin waka!”
wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.
My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?