Den Elisha tell am, “For dis same time next year, yu go karry yor son for yor hand.” Den di woman ansa, “No o-o! My oga! Yu bi God profet, so make yu nor deceive mi yor savant.”
Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.