15 Elisha kon sey, “Make yu koll am kom.” So Gehazi koll am and di woman kon stand for di door-mot.
So Elisha tell Gehazi, “So na wetin yu wont make I do for am?” Gehazi ansa, “Dis woman nor get pikin and en husband don old.”
Den Elisha tell am, “For dis same time next year, yu go karry yor son for yor hand.” Den di woman ansa, “No o-o! My oga! Yu bi God profet, so make yu nor deceive mi yor savant.”