24 But wen dem rish Israel kamp, Israel pipol kill dem well-well and di remainin ones kon dey run; but Israel pipol porshu and kill dem as dem dey run.
Dem distroy di town and each of dem kover all di good land wey dey der, with stones. Dem stop di place where wota for dey flow kon kut all di betta trees for der. Dem distroy evriwhere escept Kir-Heres wey bi di main town. Den di men wey karry katapault kon attack and distroy am.