21 So, wen Moab pipol hear sey di kings dey kom fight dem, dem gada evribody wey fit wear soja uniform, both small and big kon go stand for di borda.
Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
Di next morning, around di time wen dem won offa di meat ofrin, wota flow kom from Edom kon full di land.
Wen dem wake-up di next morning, di sun dey shine on-top di wota and Moab pipol for di oda side si am kon sey di wota red like blood.
So, make una stand well-well kon tie trut like belt round una waist, den wear bullet proof koat as raitiousness for una body.