17 even doh una nor go si breeze or rain, wota go full di wildaness and una with una animals go drink beleful.’ ”
and e sey, “Dis na wetin God dey tok, ‘Make una dig gutta for di wildaness;
But for en pipol, E turn desert to where wota full and dry land to where wota dey flow pass,
As dem dey pass thru Baka Valley, Yu dey provide wota for dem, bikos Yu make rain fall full der.
I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.
Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert; E tear rock open, Yes! E make wota flow kom out from di rock.