Six years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di sixt mont, di leaders for Judah kom meet mi for my house and at wons God Spirit kon enter my body.
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen.
Make awa oga tell wi yor savant make wi look for anybody wey sabi play jita. Den wen ever di wiked spirit kom from God kon enter yu, e go play di jita and yu go kon dey okay.”
Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,