Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 3:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Elisha kon ask Israel king, “Wetin mi and yu get togeda? Make yu go meet yor papa and mama profets.” But Israel king ansa, “Nor tok like dat, bikos na God bring dis three kings togeda make Moab king and en pipol for kill us.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 3:13
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”


Naw, send message go gada Israel pipol kom meet mi for Mount Karmel with Baal 450 profets and Asherah juju 400 profets wey Jezebel dey support.”


So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”


Den Israel king sey, “True-true, na God bring us kom here so dat Moab King and en pipol go kill us.”


King Jehoshafat kon sey, “True-true, God dey tok thru am.” So di three kings kon go meet am.


Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.


Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


Di demons kon hala, “God Pikin, make yu leave us o-o, abi yu kom sofa us wen time neva rish?”


Jesus ansa am, “Mama, why yu dey tell mi? My time neva rish.”


So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.


And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive?


Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom save una wen una dey trobol.”


So Naomi tell am, “Si, yor husband broda wife dey go back go meet en pipol and en god. So make yu follow yor husband broda wife go back!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ