Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 25:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 25:8
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.


For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.


For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.


E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.


But bikos awa grand-grand papa dem make God for heaven vex, E kon allow King Nebukadnezzar for Babilon, wey dey rule Kaldean kingdom, attack and distroy di temple kon karry di pipol go Babilon as prisonas.


so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”


Before, pipol and kings for oda nashons nor ever tink sey enemies go fit attack Jerusalem, tok-less of to skata am.


“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ