Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.
Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”