But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa.
kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.
For di sevent mont for dat same year, Ishmael wey Elishama pikin, Netanaya born, wey still bi memba for di royal family and one of di king main offisa kon go meet Gedalaya for Mizpa and e karry ten men follow body. Wen all of dem dey chop togeda,
Dem dey fear wetin Babilon pipol go do wen dem hear sey Ishmael kill Gedalaya, di govnor wey Babilon king choose. As dem dey go, dem kon stop for Kimham wey dey near Betlehem.