20 Nebuzaradan karry dem go meet King Nebukadnezzar for Riblah.
Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.
For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.
Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.
Na God skata dem and E nor dey help dem again. Pipol nor dey respet dia priests or honor di leaders again.