Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa.
King Zedekaya send Pashhur wey Malkijah born and Zefanaya, di priest wey bi Maaseaya pikin, go meet Jeremaya, but God don tell Jeremaya before dem rish der. Zedekaya sey make dem tell Jeremaya sey,
Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
sey di Oga wey bi Israel God wey dey rule di nashons get message for am. Tell am sey, ‘Just as yor mind tell yu, na so too yu send leta go give Zefanaya di priest wey Maaseaya born; di oda priests and all di pipol wey dey Jerusalem.’ For yor leta, yu tell Zefanaya sey,
Nebuzaradan wey bi di ofisas oga, take Seraya wey bi di High Priest, Zefanaya wey bi di sekond priest with three shief wey dey keep di gate kon karry dem go as prisonas.
So dis na wetin mi God dey tell una. ‘I gri sey di town na pot and na pipol wey una kill bi di meat! So, una nor go stay here again, bikos I go remove una from di town!