Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 25:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 25:15
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hiram still make shovel, basin and plates. E finish all di work wey Solomon gi-am for God temple.


Dem still karry di pots, shovels, trimmin shear, pans and all di tins wey dem make with bronze wey di priest dey use.


Di bronze tins wey King Solomon make for God Temple, plus di two pila, di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea,” di twelf bronze bull under “Di Sea” and di stand wey dem dey move, dey too heavy to karry.


Wen dem don finish, dem karry di silva wey remain go give di king and Priest Jehoiada. Dem use am make difren tins for God Temple: tins wey dem take dey serve God for di temple; tins to take burnt sakrifice; pans with oda tins wey dem use gold and silva take make. Wen Priest Jehoiada dey alive, dem dey always burnt sakrifice for di temple.


E still make seven lamp for di lampstand, with trimma and tray wey bi pure gold.


Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ